Info
Una welcome to NESG Radio. This na the ogbonge radio channel wey we dey bring sabi people to tuk solution to better the life of Nigerians.
Today we get Wilson Erumebor. Wilson be Oga economist for the Nigerian Economic Summit Group.
Wilson go yarn us sake of sey the ochara report wey NESG just carry comot. 2021 Macro Economic Outlook Report.
Wilson welcome. Make we first sidon look Nigeria economy for the year two thousand and twenty. Nigeria chook head for anoda economic recession gbege
...
See More
since two thousand and sixteen. Market begin cost wey you dey call inflation rate. Money dey reduce for government kolo, wey oyinbo call external reserves, even naira begin dey call dollar oga, and other foreign money don cost pass naira. How we take find we country for dis gbege?
2 months ago
#2021, #africa_business_news, #africa_business_radio, #macroeconomic_outlook, #nesgradio, #nigerian_economic_story, #nigerian_economic_summit_group